US President, Donald Trump don give condition before e go leave di White House even though e go dey hard for am to agree say Joe Biden win di election.
>Dis na di US presidential election results latest update since afta Trump begin drag say im no go accept defeat.Oga Trump say im go leave di White House if di Electoral College officially confam Joe Biden victory when dem meets next month.
>On Thursday, tori pipo ask president Trump weda e go agree to leave di White House if e lost di electoral college vote and e reply say; "Certainly I will, certainly I will and you know dat."..~~~~~~~
...President Trump and im supporters don file alias lodge plenti-plenti legal challenges ova di election, but most of dem don dey dismissed.
https://www.bbc.com/pidgin/tori-55097686