i makers of Whitenicious for dia website tok say, 'dis cream na to correct those hard areas of di bodi like dark knuckles, knees, elbows, bum bum and oda parts wey dey turn black by force'.
World Health Organisation (WHO) say Nigeria na di number one customer of skin bleaching cream.
According to WHO, women dey believe say di more dem yellow, di more dem go fine, dey successful and marry.
Sabi pipo say bleaching cream dey spoil di skin sotay e fit cause cancer.