https://www.bbc.com/pidgin/articles/c62drl00lj9oDi Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) on Sunday, 15 September begin dia first petrol loading from Dangote Petroleum Refinery.
Member of di Presidential Committee on di Sale of Crude oil and Refined Product, Zacch Adedeji, tok say from 1 October, di NNPCL go begin di supply of about 385kbpd of crude oil to di Dangote Refinery and na naira dem go take pay.
According to Adedeji wey also be di Chairman of di Federal Inland Revenue Service (FIRS), Dangote Refinery go supply PMS and diesel of equivalent value to di domestic market and receive naira.
“I dey glad to announce say all agreements don dey completed and loading of di first batch of PMS from di Dangote Refinery go commence on Sunday 15th September,” Adedeji tok.
Oda agreements wey di committee reach include di sale of diesel in naira by di Dangote Refinery to any interested off-taker and na only NNPC dem go sell Premium Motor Spirit (PMS) to.
Na about 300 trucks NNPCL wey belong to NNPCL bin arrive for Dangote refinery for Ibeju-Lekki area of Lagos on Saturday, 14 September ahead of di petrol loading.
Questions wey Nigerians dey ask be say wetin dis go mean for dem? E go make petrol dey more affordable or make am more available?
>Petrol fit dey more available, not more affordableNigeria economist wey get beta experience for di Energy Sector, Dr Okey Okere, tell BBC Pidgin for interview say di major challenge na di fact say NNPCL go be di only buyer of Dangote Premium Motor Spirit (PMS), so na dem go kon dey sell to di oda oil marketers.
"Dat one go make di NNPCL anoda monopoly, and even though dem dey claim say goment hand don comot for di company, we know say e still dey for goment hand and e go still behave like goment institution wey we know through di years say dem no too dey efficient," Dr Okere tok.
Also, e tok say infrastructure na anoda factor.