https://www.bbc.com/pidgin/articles/c80rg8k4ekvoMaria Makgato and Lucia Ndlovu, bin dey look for food for one farm near Polokwane for di northern province of Limpopo for South Africa in August, wen di owner of di farm, Zachariah Johannes Olivier, allegedly shoot dem die.
E come carry dia dead body give im pigs to chop in attempt to cover di evidence according to di accuse.
Di matter don cause plenty anger for di kontri wey still neva fully recover from di experience of apartheid wey happen for many years.
Court go now decide weda to grant bail to di 60-year-old white farmer and im two employees, 19-year-old Adrian de Wet and 50-year-old William Musora, ahead of dia murder trial.
Di three men neva enter dia plea for court. Dat one go happen wen dia trial go start proper.
During di previous hearings, protesters bin gada outside court to demand make di suspects remain for custody.
Walter Mathole, di brother of Maria Makgato tell di BBC say di incident don worsen di racial tension between black and white pipo for South Africa even though e don pass 30 years since di end of di racist system of apartheid.
Di three men for court dey also face charges of attempted murder for shooting at Mabutho Ncube, di husband of Lucia Ndlovu - one of di women wey die.
Mr Ncube bin dey wit di women wen di shooting happen on August 17, but e manage to crawl away after bullet hit am, and e later call a doctor for help.
Na im also report di matter to di police who say dem find di decomposing bodies of im wife and Maria Makgato for di oga Olivier pig farm some days later.
Mathole tell BBC say e follow di officers inside di pig farm wia e see as pigs don partly chop im sister bodi.
Tori be say dem bin go to dat farm to look for food wey don expire or wey don dey near to expire. Food like dat na wetin pigs dey normally chop.
Di family of Makgato tok say dem dey devastated by her death, especially her four sons wey di oldest na 22 years and youngest na just five years old.