https://www.bbc.com/pidgin/articles/c204jpq23vdoOn Wednesday, one video comot wey quote Nigeria President Bola Ahmed Tinubu wia e urge Nigerians to "look beyond wetin dey happun for di kontri at di moment even if di time dey hard".
Di video capture wia Tinubu also say tins go still beta for di kontri as e dey try im best to provide wetin Nigerians need.
Dis alleged 'new comments' from Nigeria president dey come just days afta im urge e kontri pipo wey dey hold nationwide protests to suspend dia demonstration and give e govment time.
But di President aide on media and strategy, Bayo Onanuga hours later come out tell Nigerians say di video na old one.
BBC Pidgin torchlight di video and see say true-true di video na from 31 July 2023.
“Dis period fit dey hard on us and no doubt say e dey tough, but I urge make you look beyond di current temporary pain and aim at di larger picture,” na so di video wey get President Tinubu inside tok.
For ova six days, many youths across Nigeria hold demonstrations and ask di goment to address concerns around rising cost of living, reversal of di subsidy removal, corruption and unemployment.
Di protests wey dey peaceful for some states don also witness alleged extra-judicial killings by security operatives especially for Nigerian northern states of Borno, Jigawa, Kaduna, Niger and Kano.
Dis protest don raise many concerns and dis make di president do one nationwide broadcast on Sunday 4 August 2024.
Dat na di only time since di protest start President Tinubu don address Nigerians, according to oga Bayo Onanuga.
Dis period of hardship and di clamour by some say di President no do enough form e Sunday address to di protesters na im fit don make many believe say di post wey di president official handle make on Wednesday na new video.