https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjdl3yy80zdoEmergency workers for Spain dey work around di clock to find pipo wey dey miss afta flash flooding wey happen between Tuesday and Wednesday don kill more dan 200 pipo so far.
But more rain dey expected to fall on Friday and Saturday in some places.
E neva dey clear how many pipo wey dey miss but goment don send hundreds of soldiers to di province of Valencia wey be one of di worst-hit areas, to help wit di rescue operation.
For some areas, di equivalent of one year rain na im fall for inside just few hours, and e cause massive floods wey sweep away towns and trap plenty pipo for inside dia house.
For some places, na only helicopter fit go dia becos mud, debris and piles of cars don block di road. One BBC tori pesin say communities dey devastated.
Spain don declare three days of mourning for di pipo wey die.
Di rainfall wey come wit strong winds and tornadoes na as a result of wetin sabi pipo for weather mata dey call DANA - Spanish acronym for high-altitude isolated depression.
E affect large areas for di south and east of Spain.
Reports dis Friday morning tok say di "Dana" weather system wey cause di flooding rainfall don dey weaken now, but more rain dey expected to fall on Friday and Saturday for some places.
Rainfall warnings dey in place for areas wey dey north of Valencia - especially around Tarragona and Castellón regions, as well as Menorca and Mallorca. Also for south-west Andalucía around Huelva and Condado.
For dis regions, rainfall fit reach 100mm ova di next 12 hours. As di ground don already dey saturated wit water, e fit cause even more flooding.
But di rain suppose calm down by Saturday, and a much weather dey in di forecast across Spain by Sunday.
Spanish Prime Minister Pedro Sanchez tok say flood victims "no go dey abandoned" and say dem go rebuild towns and cities wey di floods affect.