https://www.bbc.com/pidgin/articles/c62gpwqwkywo“My husband follow im team go work dat day, in di evening im team members call me say dem rush am go hospital. When I reach di hospital, doctors no gree me to see am dat night. Dem gather round am say dem dey treat am. I bin dey hear im cry as im dey in pain.
For morning, di hospital say dem wan do one test on am, say make I bring money, I rush home to go find money, wen I come back dem say e don die.”
Mrs Ifeoma Dorathy Ugwu wey her police officer husband die during di EndSARS nationwide protest of October 2020btok as she tori how her husband die as di kontri mark di fourth anniversary of dat deadly nationwide protests.
She tell BBC Pidgin how her husband Inspector Maurice Ugwu die in di line of duty for Lagos Southwest Nigeria and leave am with 4 children.
She say she be house wife since her husband marry her for 1998 and she no get any work wen di officer die. Now, she dey struggle to feed and take care of her four kids.
Her husband die on 22 October after unknown pipo attack am, two days after di deadly protest for Lekki tollgate where soldiers open fire on protesters.
Police oga dat year Mohammed Adamu tok say 22 of dia officers loose dia lives during di protests as hoodlums target security personnel especially police.
Hoodlums also burn or destroy 205 police stations during di protest.
Di protest also lead to di death of plenti civilians and soldiers. Looting and destruction of properties worth billions of naira follow for oda tins wey happun during di protest.
Amnesty International say about 56 die during di protest, say 12 of dem die for Lekki Tollgate wit plenty pipo gather to do protest but soldiers open fire on dem.
Her husband na just one out of plenti police officers wey die during di EndSARS protest.
Plenti Nigerians especially youths enter street nationwide to protest against police brutality and killings. Dem bin demand make goment special police division dem dey call SARS.