https://www.bbc.com/pidgin/articles/ckgw7ln5qwzoDi second of di US presidential debates go take place next Tuesday and dis go be di first time wey Donald Trump and Kamala Harris go face each oda.
Di presidential debates dey widely watched on television and e fit get big influence on how Americans go decide to vote.
Kamala Harris get record as better debater wey sabi, but Donald Trump also show for di 2016 and 2020 presidential debates say im be big rival.
>Wen be di presidential debate and wetin be di rules?Di debate go take place for Philadelphia on 10 September. E go start by 9 pm, Eastern Time.
Dis na di second presidential debate of 2024. Di first bin hold for June between Donald Trump and President Joe Biden, bifor e decide to drop out of di race.
Di debate go dey live for ABC and ABC News Live go stream am, Disney+ and Hulu.
E get strict time limits. Each candidate get a maximum of two minutes to ansa questions from di moderators and go get two minutes to counter dia opponents.
Di candidates microphones go dey muted wen di oda pesin dey speak, and audience no go dey di debating room.
Ms Harris bin want make di microphones dey live throughout but recently she bin agree to di rule.
E dey introduced four years ago afta di first debate between Mr Trump and Mr Biden face interruptions and quarrels.
Tuesday debate go dey run by two moderators, David Muir and Linsey Davis, both of dem dey present news programmes on ABC.
>Wetin be Kamala Harris strengths as a debater?Kamala Harris don participate for election debates eva since 2003, wen she bin win di race to be San Francisco district attorney.
She also take part for debates during her successful campaigns to be elected as California attorney-general and as a US senator for California.
She debate wit Joe Biden for 2019 wen running for di Democrat presidential nomination, and she face off against Mike Pence for di 2020 vice-presidential debate.