Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[10 / 0 / 14]

‘Wen we die, nobody go know': Diaries from Gaza

No.1234421 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/c4n4z40eve2o

Four pipo for Gaza record life under bombardment for BBC World Service, dem describe long days of searching for food and water and longer nights dey hide from air strikes, praying to stay alive until morning.

Israeli forces don dey bomb Gaza Strip since 7 October, killing more dan 10,000 Palestinians, according to di health ministry wey Hamas dey run. Dem launch di strikes in response to Hamas attack on Israel, wey kill more dan 1,400 pipo and take at least 242 hostage.

Unstable phone networks and communications blackouts don make am difficult to stay in touch, but our contacts send messages and videos wen dem fit.

Warning: Dis article contain graphic descriptions

Friday 13 October
Israeli planes drop leaflets telling residents for northern Gaza to evacuate to di south before one ground invasion, for dia own "safety and security".

Farida: Farida na 26-year-old English teacher for Gaza City. "Three of my neighbours house don dey destroyed. We all get to evacuate but we no get anywhere to go," she tok for her first message. "We just dey wait. Several of my friends dey miss, dem fit don die. I no know about my parents."

She head go south, dey waka with her siblings and dia six young children. Dem waka for almost one week, dey sleep for streets. Dia aim na to pass Wadi Gaza, to di area Israel say go dey safe.

Adam: On di same day, for di southern city of Khan Younis, Adam, one youth worker dey prepare to evacuate for di fifth time in five days.

"Dem ask over one million pipo from north Gaza to head south, to Khan Younis specifically," e tok. "But Khan Younis dey record to air strikes. One happun very close to my home."

Food, medicines, and petrol stocks don reduce afta Israel impose a complete siege on di Gaza strip and Adam no fit get di care wey e need for im elderly father, wey get Parkinson's disease. Dem no fit find bed for am for hospital either. Di night before, dem sleep for ground for di hospital yard.