Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[23 / 1 / 8]

How farmer survive crocodile attack afta e bite di animal back

No.1235717 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cj5pr8n30j7o

One Australian farmer wey bite crocodile wey attack am, say im dey lucky to dey alive.

Colin Deveraux na cattle producer wey bin spend one month for hospital afta one saltwater crocodile wey reach 3.2m (10ft) bite am for Northern Territory.

Im tell ABC News say im bite di crocodile eyelid as im dey struggle to survive.

Oga Deveraux say wahala start afta im stop for billabong (lake) as im dey travel to build fencing near di Finniss River last month.

Im bin stop for di lake side afta im notice fish dem wey bin dey swim for di middle of di waters. Afta im step away again, na im di crocodile "grab" im right leg, begin shake am like "rag doll" and pull am inside water.