Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[9 / 1 / 1]

'International oil companies no fit leave witout cleanup for Niger Delta' - Environmental activists

No.1368957 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/c9q7yx0nwgvo

"No divestment witout remediation!" Na di demand of some Niger Delta environmental activists wey carry protest go Rivers State Government House for Port Harcourt, Southern Nigeria.

Di protest by environmental advocacy groups like Social Action, Health of Mother Earth Foundation (HOMEF), Kebetkache Women Development and Resource Centre, We The People and some local communities dey ask Nigeria President Bola Tinubu not to allow international oil companies (IOCs) to go on wit di divestment process wen dem never clean up di many sites wey oil spillage don damage across di Niger Delta region.

Dr. Prince Edegbuo of Social Action explain to BBC say dem want make President Tinubu maintain Nigeria Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) rejection of Shell request to sell dia remaining shares for Shell Petroleum Development Company SPDC to Renaissance Consortium.

E say oda international oil companies like TotalEnergies dey also attempt to sell dia stakes for SPDC and oda Nigeria onshore oil assets, kon add say approving di sale of Shell SPDC share go send a dangerous message to all multinational corporations wey dey operate for Nigeria say dem fit extract di resources, leave devastation behind and waka comot witout any consequences.

"Any approval of Shell and Total request to divest go weaken regulatory independence, ignore di interests of di Niger Delta communities, jeopardise di environmental and social wellbeing of di region for generations to come and e go undermine Nigeria sovereignty."

"Our demand na say dem no fit do divestment witout di clean up of all di communities across di Niger Delta wey oil spill from dia facilities don damage finish!" Na di position of Ken Kentebe of HOMEF.