[7 / 1 / 1]
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cm2yp58pj9zo
Di State of Emergency wey President Bola Tinubu impose for Rivers State on Tuesday night go officially take effect if two-third of di members of di National Assembly vote to approve am.
Dat na according to di Nigeria constitution, and e dey expected say di lawmakers go meet today to vote on di matter.
BBC dey monitor di situation and go bring you di tori as soon as e happun.
Di announcement by President Tinubu surprise many Nigerians and already, plenty political sabi pipo and groups don dey chook mouth.
Tinubu tok say e take di decision sake of how di political crisis for Rivers State dey get worse and e don lead to destruction of federal goment oil infrastructure for di state.
"No good and responsible president go standby and allow di grave situation to continue witout taking remedial steps prescribed by di Constitution to address di situation," Tinubu tok as e invoke section 305 of di Nigerian constitution to declare a state of emergency for Rivers state.
>Wetin dey section 305 of Nigeria constitution?
For Nigeria, na section 305 of di constitution give di president power to declare a state of emergency, and di conditions for dat include:
- If di kontri dey for war
- If real danger dey say di kontri fit dey involve for war, or say di kontri fit dey invaded
- If actual breakdown of public order and public safety for di kontri or any part of di kontri dey, wey require extraordinary measures to restore peace and security;
- If danger dey say breakdown of public order and public safety fit happen for di kontri or any part of it, and extraordinary measures dey necessary to avoid am
- If ogbonge natural disaster happen for di kontri or any part of am, or if danger dey say big natural disaster fit happen wey go affect pipo wella for di kontri
- If any oda public danger dey wey go be threaten di existence of di Federation
- If di governor of a state, wit support from di state assembly, ask di president to do so