[8 / 1 / 1]
Quoted By: >>1435959
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cr4q2zg9rz3o
Dem shoot Charlie Kirk, one influential right-wing activist and close ally of US President Donald Trump, on Wednesday,10 September, as e dey tok for one event for one university for Utah.
On Friday, 12 September, President Donald Trump tok say di suspect dey for custody, for one interview wit Fox News: "I think we get am."
"Essentially, na pesin wey dey very close to am turn am in."
Na Oga Trump, too, bin first announce say im paddy, Kirk, don die afta dem shoot am for neck for Utah Valley University on Wednesday.
BBC US partner CBS report say one law enforcement source don identify di pesin for custody as 22-year-old Tyler Robinson.
Di arrest come less dan one day afta FBI release one blurry foto of a "person of interest" wey dey wanted for di shooting.
Investigators bin beg di public to help identify di suspect, wey wear sunglasses, Converse shoes and one "distinctive" long-sleeved black top wey feature American flag and one eagle.
For one press conference on Thursday night, Utah govnor Spencer Cox bin also release one video of wetin police believe say na di suspect as e dey run from di scene.
Di FBI earlier dat day bin tok say dem recover one high-powered firearm - one imported Mauser .30-06 bolt action rifle – wey dem wrap for towel for one wooded area.
>Wetin hapun?
31-year-old Kirk, bin dey tok for Utah Valley University for Orem on 10 September, 2025 as part of im "American Comeback" tour.
E sit down under one white gazebo to take questions from crowd of about 3,000 for di university "quad", one outdoor courtyard.
E bin dey ansa questions about mass shooting. Den one single shot fire, wey pipo believe say come from di roof of di Losee Center, one building wey dey overlook di quad.
Kirk come fall from in chair wit clearly visible wound for im neck. E dey bleed seriously and im staff carry am comot for stage.
Di crowds around di tent begin run and pipo begin shout.