Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[4 / 1 / 2]

X briefly suspend account of Alexei Navalny widow

No.1269443 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/crg5v02rxkgo

Dem briefly suspend Yulia Navalnaya account on X - formerly Twitter - one day afta she use di platform vow to continue her husband campaign.

On Monday, she bin post one video wia she promise to fight for a "free Russia", days afta Alexei Navalny death for one Russian prison dey confirmed.

On Tuesday afternoon, her account bin no dey accessible to users for a while.

For inside one statement, X tok say dem "mistakenly" block di account sake of one system "error".

One post on di site official safety account read: "Our platform defense mechanism against manipulation and spam mistakenly flag @yulia_navalnaya say she violate our rules.

"We unsuspend di account as soon as we notice di error, and we go dey update di defense."

Ms Navalnaya, wey bin generally keep low profile throughout her late husband campaigning, bin create di account on top X on Monday.

For one video message she post di same day, Ms Navalnaya accuse Russian authorities say dem wait make di traces of di deadly nerve agent Novichok disappear from her husband body before dem release am to im family.

Di Kremlin say di accusation na false and investigation into im death dey ongoing.

Many users bin share di emotional video statement, wey show as her voice dey shake wit grief and anger.

Her account bin gada more dan 100,000 followers since she create am.

According to X guidelines, dem fit suspend accounts for posting spam or abuse, or if di security of account dey at risk.

>Meet Yulia Navalnaya di 'principled and fearless' widow of Putin opponent Alexei Navalny

Alexei Navalny wife, Yulia don always keep low profile as she insist say her main role na to be wife and mother, no be politician.

But wit her husband death on Friday and her passionate appeal for justice for di Munich Security Conference, she don emerge as one major figure for Russia opposition perhaps by default.