Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[8 / 1 / 2]

At least 28 out of 280 schoolchildren escape from bandits

No.1276516 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cekenz408p3o

At least 28 of di almost 300 pikin dem wey gunmen kidnap don escape, na wetin Kaduna state govnor tell BBC News.

Nigerian Army dey find di pikin dem wey dem gbab from di northern town of Kuriga on Thursday 7 March.

Sojas dey work wit police and local search teams to search for inside di forests for Kaduna and oda states.

Na gangs of okada men wey get weapons gada di almost 300 primary and secondary school pikin dem between di ages of eight and 15, school authorities and parents tok.

One pikin wey dem bin reason say na 14 years bin collect bullet from di gunmen and don die since.

Kaduna govnor Uba Sani tell BBC say di lack of sojas for ground na im be di cause of increased kidnapping for di area.

Almost evri family for di town get pesin wey dey among di pipo dem kidnap.

Parents and relatives of di pipo wey dem kidnap don arrange to form vigilante groups and dey ask for help from oda communities close by to see if dem fit find wia dia pikin dey.

Dem dey search for Kastina and Zamfara states as well.

Nigeria Vice President Kashim Shettima dey go Kaduna and dey plan to meet di govnor.

President Bola Tinubu tok for social media say e dey confident say di hostages go dey rescued.

One teacher for Government Secondary School Kuriga for Kaduna state, north-west Nigeria say di gunmen wey storm di school on Thursday, 7 March kidnap 280 pupils and teachers afta head count.

Sani Abdullahi give dis informate wen di Kaduna state govnor, Uba Sani visit di community.

Gunmen bin ride motorcycles enta LEA Primary and Secondary School, Kuriga wen di students dey for assembly ground around 8:30am and kidnap di students wey dey between di ages of eight and 15 and teachers.

Dem shoot one girl wey currently dey for hospital now.

Govnor Sani say security agencies don dey find di missing children.

E say im don brief President Bola Tinubu and di National Security Adviser on the Kuriga situation.