Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[3 / 1 / ?]

Wanted traditional ruler wey dem link to Okuama soldiers murders dey military custody

No.1283209 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cz5z23mn787o

Di king of Ewu Kingdom for di Ughelli South local goment area of Delta State, Clement Ikolo, wey dey among di eight pipo wey Nigerian Army bin declare wanted in connection to di killing of 17 military personnel for Okuama community don dey military custody.

Di tok-tok pesin for di Delta State Police Command tell BBC News Pidgin say dem hand di traditional ruler to di military on Friday 29 March afta im turn imsef in to di police on Thursday 28 March.

Di monarch bin arrive di state police command headquarters at exactly 6:41pm on Thursday to report imsef to Police Commissioner, Olufemi Abaniwonda.

Bifor e turn imsef to di police, di traditional ruler bin speak to journalists and insist say im dey innocent.

Di Nigerian Army don declare eight pipo wanted sake of di killing of soldiers for Okuama community of Delta State on 14 March.

For dia X page on 28 March, di Army publish photos of di wanted pipo wey dem dey find in connection to di killings wey shake di whole kontri.

Nigeria Chief of Defence Staff, Major General Christopher Musa bin earlier tok say di Nigeria Army sabi who dey responsible for di killing of 17 soldiers from 181 Battalion wey bin go peace mission for Okuama community for Delta State.

For one press briefing wey di CDS give, e bin tok say dem kill Lieutenant Colonel A.H. Ali and im men sake of say im bin dey try end illegal oil bunkering wey dey happun for di Niger Delta creeks.

“We sabi who do dis tin, we dey follow am up, and na just a mata of time, we sure say we go get am,” General Musa bin tok.

E say many of di militants wey dey do oil bunkering dey get plenty weapons and na one of di ones wey dey benefit from am na im kuku use di opportunity of di fight between di two communities to kill Lt. Col. Ali.