Domain changed to archive.palanq.win . Feb 14-25 still awaits import.
[16 / 1 / ?]

Wetin dey cause kasala as Israel say dem go take action against Iran wen time reach?

No.1287133 View ViewReplyOriginalReport
https://www.bbc.com/pidgin/articles/c3gl39w1el4o

Anoda kasala don begin happun, but dis time around na between Israel and Iran.

Di attack involve drones, cruise missiles and ballistic missiles. Iran bin launch

more dan 300 drones and missiles towards Israel on Sunday, di Israeli military tok.

Di attack include 170 drones and 30 cruise missiles, but none of dem enta di Israeli territory.

Dem also fire 110 ballistic missiles, and na small number of di ballistic missiles reach Israel, military tok-tok pesin, Rear Admiral Daniel Hagari tok for statement wey dem show for television.

Di BBC neva independently verify di figures.

Di shortest distance from Iran to Israel na about 1,000km (620 miles) across Iraq, Syria and Jordan.

>Israel say dem go take action against Iran wen time reach

Israel go "exact a price" from Iran in response to dia attack on di kontri wen di time dey right, war cabinet minister Benny Gantz tok.

For one statement bifor Israel war cabinet convene, Gantz say: "We go build a regional coalition and exact di price from Iran in di fashion and timing wey dey right for us.

"And most importantly, faced wit di desire of our enemies to harm us, we go continue to unite and become stronger."

Separately, Gantz tok say im don speak wit German Foreign Minister Annalena Baerbock.

"We bin discuss first and foremost di imperative of forming a global united front to counter emboldened Iranian aggression directly and through dia proxies - regionally and globally," Gantz tok dis one for one social media post.

>Wia Iran launch di missiles from?

On Saturday night Iran Revolutionary Guards Corps (IRGC) say dem launch drones and missiles.

Iraqi security sources tell Reuters say dem see projectiles wey dey fly ova Iraq dey go Israel direction.

Di IRGC say dem fire di ballistic missiles almost one hour afta di drones wey dey waka small small so dat dem go strike Israel almost di same time.